Lyrics Of The Day - HERO by Tim Godfrey & D Xtreme Crew




Verse 1 
Wetin I for do who I for call o 
If e no be You how I for run o 
Baba o, na You rescue me e e e 
No money for pocket 
No food to eat 
My shoe na so so alignment, no house to sleep 
You come rescue me 
That’s why You be my hero 


Chorus 
Oh na only You be my Hero 
Na only You I go follow 
Why You love me so
Even when I don loose hope 
Everybody give me long rope 
You come rescue me 
That’s why You be my hero oh 

Verse 2 
Na so dem dey call me mumu 
Their mouth dey chop me like fufu 
Dem yab, dem laugh me, reject me, eject me 
Dem even say I no go school 
Thank You baba u no dey look face, thank You Baba 
You no get two face, na You rescue me 
That’s why You be my hero. 

Bridge 1 
I dey lonely, only me 
You come love me 
Come lift me 
My spirit, my soul take control, my heart and 
My love 
My hero oh…oh…my hero 

Bridge 2 
When dem reject me, eject me, dem wound me 
Dem wan kpai me, dem no know say na 
Because of You i still dey o! 

Refrain: 
Na only You be my hero 
Na only You I go follow


Comments

Popular Posts