Prayer Mountain

I tanda for my porch with my nebor [Linus] dey yan when tori carry us enter prayer matter. Na den Linus gist me about one powerful "Ori Oke": to pai the long story short, Linus swear say "Ori Oke Oluwatise" na express road for prayer to heaven.

Early morin the next day, na im I set out for Iwo-Road go join bus wey go carry me [kaya] go "Ori-Oke Oluwatise". E never reach three minutes after I enter the bus before the bus full [Bamu!]. 



Few minutes before our bus commot garage, one passenger [na woman] nak this prayer give every one of us as if say we dey set out go fight ISIS. The prayer never finish before the red-eye driva crank the enjin start moto. As I look the driver eye, I dey 99% sure say the guy don dey like 5-6 shots of kain-kain, but the way the guy eye bulge open give me confidence say he no go sleep for steering.

As we reach "Ori-Oke Oluwatise", I comot moto, start to dey climb ["Ori-Oke Oluwatise" get three levels]; I climb to first level, second level, as I reach third level, I see say the "Oke" get attic, na im I waka up one more level enter attic.


As I reach attic, I kneel down dey pray: I never pray one hour when I see Angels dey desend from heaven for elevator [if you remember, for Jacob time, na ladder angels dey use waka come earth from heaven, but Angels sef don dey tech compliant these days].


As I see the first Angel desend, I remember say Jacob resle Angel for Jabbock before im collet im blessing. Na dis understanding I carry near the Angel. Na so I try hol the Angel, come dey talk like bro Jacob say "Angel, I no go let you go unless you bless me". The Angel come hol me, im grip be like say na 1000 Mike Tyson hol me. At first I think say the Angel dey provoke; when I look the angel face I see say im dey smile to me. The next tin when I notice be say the angel hand dey waka go my thigh bone [but for my body, soul and spirit, I know say I no wan carry THREE legs waka comot "Ori-Oke Oluwatise" like bro Jacob]. E remain small before the Angel hand touch my thigh bone, na im I scream say "Sir, I beg, please wait". Na im the angel stop, but im still dey look me dey smile, but im relax im grip on me.

Na im I change my word dey talk say "I will let you go because I sure say you go bless me". As I dey talk I dey try wiggle myself comot the Angel grip. As I wiggle free, na im I go jeeje back to my prayer position, I pray small thank God dey go home with my 2 legs.

As I reach home, for the coner of my room, I nak prayer small come start praise worship; na den God come talk say im dey everywhere and im dey listen to all my prayers and petitions anywhere I for pray them. Baba Agbalagba say im dey "Ori-Oke Oluwatise" as much as im dey my closet. Na im I smile, give God thanks giving.
Later, I break my fast with a bowl of akamu with several pieces of akara Ogbomoso. I come lie down for couch dey watch the week's episode of "Agbara Nla".

Oluwaseyi Bolarinwa wrote in from Florida. In his words: "Some of my friends perceive me as an anomaly. If you care to know my opinion of myself: I am a playful, happy boy who likes to make others smile." He has a comic style of writing, adding humour to even the most serious topics.


Images: Google

Comments

Popular Posts