Lyrics Of The Day - DO MY OWN by Ola ft Obiora Obiwon


Chorus 
I know You go do my own 
Till You bless me I no go let You go 
I know You go do my own 
You go give me my victory oh 

Verse 1 
Many years don pass 
Many people dey don pass 
Many make am, many fash 
Man life be like grass 
Many dem dey laugh 
Many wise and many sharp 
Dem talk behind my back 
Dem say I too dey slack 


Refrain 
But I know You love me 
You will never fail me 
Everything wey You Promise 
Oh my Lord I trust thee 

Verse 2 
Many times I fail 
Many times dey be like shame 
Many many times  
E dey hard to hail Your name oh 
Sometimes I no fit talk 
Sometimes I no fit walk 
If Hannah, Job, David fit rejoice 
You go give me my joy 

Verse 3 
Na you I dey follow oh 
Na you be my Lord oh 
E be like say I dey kolo 
Wetin others do to make am 
I no fit if e no be Word oh 
Some say make I sharp oh 
Some say I shack tombo 
Some call me otondo 
Chi m O 
Bring out your ogologo mma agha 
Answer with fire Jehovah 
Begin to show off with my life 
Until You show off with my life 
I no go run, I no go turn my love is for thee [Jehovah come in Your love and mercy for me] 
I overcome by the blood and testimony 
[And testimony] 
By the Word of my testimony 


Comments

Popular Posts